4 hours ago

PSG's Hakimi to face trial after rape allegation

PSG's Hakimi to face trial after rape allegation

Paris Saint-Germain defender Achraf Hakimi is set to face trial over an alleged rape dating back to 2023 in Paris, an accusation the Morocco international strongly denies. French prosecutors opened a preliminary investigation in March 2023, and while no trial date has yet been set, Hakimi says he is awaiting the proceedings with confidence that the truth will come out.

Paris St-Germain defender Achraf Hakimi tok say e dey set to face trial afta allegations say im rape pesin.

One woman don accuse di Morocco captain say im rape am for im house wey dey for di French capital, Paris in 2023, wen she bin dey age 24. E deny di allegations.

Di public prosecutor office for Nanterre, wey dey western suburb of Paris, don start preliminary investigation for March 2023.

"Today, a rape accusation dey enough to justify trial," Hakimi post for X.

"Dis dey as unjust to di innocent as e take be to di genuine victims. I dey calmly wait for dis trial, wey go allow di truth come out publicly."

Dem neva set date for di trial.

Hakimi lawyer don confam inside one statement say, " dem don order trial" and say "we dey determined and ready to wait for dis trial so justice go fit hapun".

BBC Sport don contact Nanterre prosecutor office for comment.

Paris St-Germain go host Monaco for di second leg of dia Champions League knockout round play-off tie on Wednesday.

Hakimi dey among PSG initial squad wey dem publish last Tuesday.

Dis 27-year-old wey dem born for Spain, dey represent Morocco and don play 194 matches for Paris St-Germain, winning di Champions League and Ligue 1 titles for last season.

Im performance lead to am being honored at di Best Fifa Football Awards ceremony wey hold for Paris on Monday, wia dem name am inside Fifpro men's world team of di year. Morocco go face Scotland, Haiti and Brazil for World Cup wey go hapun for USA, Mexico and Canada dis summer.

Related Topics